See The Young Girl Egungun of Lagos Dated For 6 Years Before He Proposed To Her.

Popular Content Creator Egungun of LAGOS don Propose To His Longtime Girlfriend Who be dey with am When He Was Suffering With A Diamond Ring.
All the big ikebe and BBL Instagram 'baddie' don shock as Egungu engage the love of his life with no big yansh, no big breast, no bbl, not a baddie, just a beautiful woman, yet Egungun, the king of baddies picked her for a wife.
Na this same Egungun wey dey parade all the big ikebe across Africa for his pages go propose to girl with no yansh.
You go like to know say most times, na the girl dey behind the cameras of all those videos of ladies with big yansh shouting "dame, that's massive babe"
The funny thing now be say after Egungu and the wife record all those big yansh post as content to make money, dem go enter house dey laugh them while the big ikebe and BBL girls go dey online dey happy say dem dey trend .
Show me one engagement of those big girls with fake yansh. I will wait to see. Marriage takes more than those fake big yansh.
Men go look your big ikebe and BBL finish, come praise you for comment section but na there e go end. Fake big yansh no fit hold man to commit for marriage.
Men know what they really want in the end. Forget big bress and big ikebe.
You know fake ikebe na just for fun. When it comes to marriage, most men dey get sense oh.
My worry now be say who go come marry those girls with big fake ikebe them now? Wahala for person wey follow fake ikebe go marry wrong woman.
Nothing pass a good lady that can give you peace, love and happiness. Forget all those big fake yansh and big breast. Men go for peace, respect and loyalty.

Пікірлер: 1

  • @Nuelsontalkstrends
    @NuelsontalkstrendsАй бұрын

    Thank you to everyone watching this video and leaving a comment. I sincerely appreciate you. Please, consider subscribing to my channel to see more of my videos. Thank you so much💙

Келесі